african
afropop
afrobeat
Lyrics
High voltage 2025
High voltage 2025
Make you no put boby
This one na our students week
Verse 1]
Na so we land for the campus
Gbedu dey loud, everywhere burst
No dullin, vibes dey on plus
Even lecturer sef wan dance with us
Fct omouk way girl fine fine girls
Guys dem fresh, no dey miss beat
Assignment drop, we no dey see
Na groove we dey groove all week
[Chorus]
High voltage 2025
High voltage 2025
Make you no put boby
This one na our students week
[Verse 2]
Monday na rag day, on Thursday omo chill
We dey run show from hostel to court
DJ dey mix, speaker dey shock
E be like say current don cut
Na fun we dey find, no wahala
Forget stress, forget malaria
From Monday reach Saturday
Na flexing we dey display
High voltage 2025
High voltage 2025
Make you no put boby
This one na our students week
High voltage 2025
High voltage 2025
We dey on full current
Na we dey run this street
[Rap Verse]
Omo see groove, see energy
My vibe no dey low like battery
We dey charge like transformer
High voltage no be drama
Students dey ball like say na payday
Even VC self no fit talk say mayday
We dey para, we dey hala
No dull, just gimme gala
Snapchat dey hot, TikTok dey trend
Na we dey set the pace, we no dey bend
No slack, na full attack
Na enjoyment mode, no go turn back
[Chorus Repeat]
High voltage 2025
High voltage 2025
Make you no put boby
This one na our students week